Friday, 3 February 2012

POWER


Power dey sweet well well, I no won blog about this b4, but I just have to. I just dey my own jeje dey write exam, wen I no no who lecturer be(one of does courses, wen no fit put water for my cup, not to talk of butter for my bread) I dey jeje, dey write wetin me, I no no, dey do my guess work jete by jete and dey use my, glasses dey spy, nai one of the NFA invigilator, come dey miss yarn say, me I no dey sure of myself, say me I dey spy d girl work, of course I denied it cause, at that time I was not spying  her work, the man come seize my paper, he come one disgrace me for general pubic dey push me. I no even mind am self, I carry myself commot for d exam hall, as I dey go I come tell am say make him no forget to submit my paper, him give me the paper, make I go submit. As we dey go, na so e take dey pinch me, dey push me , dey tell me say, my mouth go put me for whahala and I go, go back my papa house go start life again. See me; see blessing oh, all this drama on top course wen Na ZERO unit. I no blame am, Na him go, go start life again from him village. Before una use stone take stone me, I know say I dey wrong but, on top zero unit course, dey guy go too far, wetin make e go dey pinch me for back, I resemble him pikin mschewwwwwwww
BTW: my department say, make we stay school for one more week, whether Na dem go feed me, I no know. And they girl wen, dey studio with me dey sing like man, all dis…… make I close mouth, before I miss jarn. Before I forget, I want to give a, shat at to miss pierce, for being d first, follower of dis blog, and if you read or I force u read my blog, biko comment, so I no go dey feel funky, wen e be say na people for china, mistake come across the blog.
I don talk am now……..

Tuesday, 31 January 2012

Da Lor Rainet


Da lor rainet, blessed be da lor. I just write one exam just now, and na only God, get the paper. Na abomination to carry, carry over… tufaii, alu, not my portion. Digressing sha, you fit imagine d nonsense wen  my beloved schl, do us dis morning. People of da lord, around two tarty Ahem, them announce ova da microphone “everli bodi move out of the hall” as dem talk dat won… pple of Da lor…… de hiding began , lappy, plus other unmentionables, went to where they belonged, na so as we reach out side we come get to sign in to get back inside(if all d signature wen dis sch dey, collect from us dem use am, me and dangote for be mate). AS I dey outside, I almost dey leak and I never read finish, I wan vex die……we come dey outside till 4 Ahem.. U can imagine and I get paper by 8 Ahem and i haf to get to class, by 5:30 to download read...So, pls tell me, why my paper no go be magnificence.  When I reach exam hall, 2hrs paper, na 30mins I take write am. Da lor Rainet, it’s in his hand.
BTW: one of my lecturer, after he tell me d story of my life in 45 secs, he come send me go by cabin biscuit , na so I carry my 2 left leg , go come back, d biscuit no dey, the man, come dey dat me. You  can imagine, mscheww. The man no serious, im wan use him clazzlessness, take rub me and the forces of the universe no gree for am
I don talk am now……………..

Sunday, 29 January 2012

CONTROL


If you lose control, then you lose everything. na so I take tink am. I too dey fear, I dey fear wetin never happen. And so wetin, if the tin wen I dey fear happen, so far say no be death, hope still dey. Say the person wen u love, no want to love you again….. no problem.E mean say, betta loving is ahead. Abegg if anytin won happen make e happen . Na only my actions and beliefs I fit control. So  I go face my fears, make  you sef do d same
I don talk am now……………..

BTW: I dey studio since morning and na so I waste my time today,dey download won series wen I tink sey, go give me betta tips *wink*, only for me to find out say, na yeye series, wen the woman, they talk say she no fit do d tin again, because of reasons best known to her,  some oyinbo sef.. na wa, if you try dat for some places den… OYO is your case and today I baff before I come, so I no smell….. PRAIZEEEEEEEEEE da LOR , HALELUJA

Monday, 23 January 2012

LUF MEEE


Luf me luf me luf me luf meeeeeeeeee na so sista tiwa tey sing am, but as e dey go so, no be so it take be, cus d wan wen u luf no luf you and the one u no luf dey luf u. Y all of us no fit get along as in every bodi luf each other. As for me sha, I don tire to dey pursue one peson from pillar to post because say I luf u and I wan do ashana. Na so tis luf tin dey make person turn to mumu. As fela take talk ,am zombie oh zombie. The peson wen no luf u, go they use u like say u be matt. Y u lead me I d ist place wen u no say u no wan do. Na so them go say, do dis,do dat and u go dey do like ode . na only jesu go fit help us all luf struck pple as in me  . Anyway sha I no blame dem, na us me  I  blame if I no give u finger before, u for no take leg ? mschewwwww.
BTW: I luf pidgin well well cus gbosh na part of pidgin so no editing necessary
And if I get any bodi wen by mistake or I tell u or force u reed my blog, pray 4 me cus I wan rite exam wen I don write before
I don talk am now……………..

Saturday, 21 January 2012

CHANGE


As I sidon for here.. I neva baff since morni and my ampit dey smell, even me sef wen get di bodi dey die for the odor , na wha oh… na wish day I go commot for dis my PIG-GI-RI-GI life… God dey sha.
I Don dey draw *architech in da makin, u wan tryy God*wan betta (God no go make am yeye paper)  for here since morni (na who I dey lie give) na ink and download I dey download since morning, the pple wen I meet for here sinse 8 oclock don baff, brush, chopp, commot, some do even love dem seff and dem don come bck, dem still meet me for here.. I dey beg mysef make I change commot for dis kain life. Na so so plan we *cough* me I dey plan, no ashon, well na small small sha.

BTW na pidgin go dey take write dis blog and all wetin I dey write na red e dey com out as. I need to created pidgin dishionary to avoid error
And all dis 100level shidren just dey love dem sef for here.. una never start (jelousy) lol my own is on da way HAYMENNNNN

Tuesday, 11 October 2011

Love and be loved back


There are codes you just don’t break. If your friend breaks up with a lover, you don’t jump in and use the opportunity regardless of who saw who first and even if there was no love in the relationship to begin with, you still don’t. I always believe that you should treat people the way you want to be treated. Because whatever you put in to the universe, comes back to you in direct proportion and this I am a testimony to and believe with all my heart. I have done some terrible things and the moment the thought of doing that thing comes into my mind, I hear it clearly that there are going to be consequences. And if i eventually do that deed, it comes back to me in direct proportion. So if you decide to steal, known that something is going to be stolen from you, if you decide to snatch, something is going to be snatched from you. Always try to listen to that little tiny voice that checks your moral intent. Give out love and it will come back to you in measures.
Love and be loved back in return, because it is such a beautiful feeling.
I don talk am now……………..
11-10-11