Giving da fact that I’m enjoying ma sef, and people dey school, dey receive educasion and I dey for house dey frolic, I get one question wen I won ask, the one person multitude wen dey read this blog:
· Na bad thing to dey DO with one person and to come dey imagine say, Na another person u dey DO with.
· When u and person dey DO and you say stop and person no gree stop, not to rape dat one dey turn to.
Gehs, please this question Na for una. I know say some people like one geh wen her name start with B (I no call anybody name) go defend. Me sha, I dey on the fence. I feel say you fit imagine am, as long as say, the person wen you and am dey DO no dey committed and d person no know. But if una dey committed, den I feel say u no suppose imagine am, MY OPINION. And for question number 2, how you won take judge am pass, not to you take your two left leg waka go the person house. So if you ask me, Na who I go ask…………………………
One of my friends Stella, tell me say, her friend angelica, tell am say, person tell am say (dem say dem say don come again, rumour has it people) parole dey for Abuja, dat per session Na 400k and the, who is who of Nigeria nai dey involved, (Senators, Ambassadors, Alhajis, People Mothers and Peoples fathers). In fact, dem be VIP or in my opinion VIR (Very Important Ritualist). No be juju level be dat one, 400k per session, ABEG……. d tin Na gold dem use take lace am. The money dey tempting sha BUT wen d snake dey come outside, 400k no go reach for treatment. So once again if you ask me Na who I go ask…………
BTW:I just sidon for cyber café like agbaya, dey wait make the yeye internet come up so I go fit see fashion week timetable and also my sista don land from d obodo, but she never reach house, so I dey go wait for am for airport, so dat I go get first pick for all the goodies.
After one hour, the internet never still come up, abeg I dey go my papa house, not to because of me dem invent World Wide Web, I go come back later mschewwwwwwww.
No comments:
Post a Comment