Before u DO anybody, ask yourself, if I see the person tomorrow wetin d person go talk? ,if the person go talk say, the first day wen you meet am, na dat day, nai the person see the colour of your pant or say you dey form classy (at least e better make dem say you dey form clazzy, than to talk say, you no clazzy at all) dat won na up to you. I won put the true life super story of my friend Stella. she say, yesterday she dey her papa house jeje, wen her assistant knock her door, come tell am say, her friend angelica, dey down stairs dey find am.wen she reach down, angelica come tell am say, parole dey (according to her, na her first parole be that, well…. if na true, nai be say, my CGPA na 4.99 ).say the people, one come from London, den she tell angelica say, “who she be to refuse a call from the obodo” . Na so she carry her two left leg, go ready. She nor even baff sef, she just do MDP (mouthwash, deodorant and perfume), hair sef she no brush. As reach she outside, she come see the people for inside the motor (as I dey write dis story, e dey pain me cause some people Stella, go dey call people classless). Na so dem come drive go, she Sidon for the back with the person wen come from the obodo, say Na her own. As dem dey drive dey go, she think say na hotel dem go go, before she Know, dem take road wen dey lead to angelica house ,for her mind, she say no problem cause, last last dem go use different rooms . E shock am, wen dem reach, angelica begin dey arrange room say, all of dem, go do am for the same room. She say, she come tell angelica say, she no go commot her cloth, say Na only Oral B, she go do, well….. Breeze don blow and una known the rest. End of story…. she and angelica commot cloth finish for the same room, and the obodo come say Na angelica him want and them come switch. She tell me, dat na only Oral B she do, cause CD no dey and besides she was on her period but angelica do without CD ( geh friend, ashawo na ashawo no matter what you drive). She say make I advise am, because the obodo person, want relationship with angelica and she come dey ask herself the following questions:
· The whole thing worth am? (Na lie, E dey pain am cause the obodo person no pick am)
· Because she do group tin, e mean say, she be ashawo? (Before nko)
· Wetin make the obodo go choose angelica, abi she no clazzy reach? (Duh!!!! wen you go dey do MDP and dey wear tear tear trouser, you no know abi….)
Trust me, I give am the answers below, because the ones above, no do justice:
· Woman thou art loose, and where art thou virtue
· Never sleep with anyone, the first day you meet them
· DOING is private and usually between two people
· No dey form clazzy wen you no clazzy, dey baff, dey use Brazil and if you dey bleach, make sure say, you bleach the bleaching complete (Stella Na fair girl but her behind nyash black)
· Commot for ashawo level or become a high class prostitute better still leave the business
· Bottom line…….. Woman thou art loose and where art thou virtue and no, it wasn’t worth it, so move on.
BTW: this post long sha…..I don change the Names of the parties involved, to prevent their public stoning and I write this piece, to paint someone as a victim and to make a person feel good.
I never resume school, cause My sista dey come from the obodo , so I dey wait for am, plus one big event dey happen for gidi, and I might be going, plus a reunion with an old friend is upcoming. So, educasion is on hold.
No comments:
Post a Comment