Tuesday, 21 February 2012

ONLY IN NIGERIA


Take am say this story, e fit be lie and e fit be true, so Na your choice to place am for either fiction or nonfiction, but the level of classlessness’ wen people go stoop to dey baffle me sometimes. Say man wen don marry with children  go dey follow another married man wen get pikin on top bike around town, dey check wether him dey cheat on am, na beyond foolishness. No be cheat una two dey cheat and as you don marry you no go commot for ashawo work. All I have to say is, big SHAME on you, as you old reach. I suppose get your details, send am to Linda ikeji, as e be say Na Nigerian film you won dey act up and down and you won be star. Shame no even catch you small. If person say Holy Ghost, don catch am because say your soup no sweet, you no go go house go cry for your wife breast. Can only imagine what the poor woman is going through, for her mind she don marry, not knowing say, Na honorary lesbian she be. Girls, make una open una eyes before una marry, marriage no be for everyone and no be by force. Say you be 35 and nobody dey show face, no mean say na the first person wen propose nai you go gree for. The symptoms are always there, for you to see all the things you don’t need in your life .abeg no settle for less (note to me too) you too valuable for anybody to treat you like rubbish. Anyways, as for dat yeye husband….one day bush meat go catch the hunter 
BTW: To say, boredom get address Na my papa house e go be. I don dey dis house for 1 week and e be like say na Rapuzel or Cinderella I be, wen dem trap for inside castle. Na so so think I dey think, and for the past one week light never dey and On Sunday all the guys for house no go church, When my mama come back na so holy ghost fire full everywhere .so next Sunday, na under da canopy da lord I go dey. And note to the person wen promise me pass to d big event wen dey come up for Eko, if I no go, please defer your academic sessions for the next 3 years.
I don talk am now……………..

Friday, 10 February 2012

PART 2


I don come back, and Na still Saturday (pls check at, d earlier post). As climb up, I come look my bodi, as I injure, all my skin don scatter finish and toning Bleaching don dey I vain. the situation big pass me so, I decide say, I go, go hospital with my friend, as we reach hospital dem treat me finish, we come say make we go outside school go buy food, as we dey trek come back  we come see the hospital bus, dey park inside d hospital. Na me I come remember say, I clazzy, so I no fit dey trek.  As we reach, we come enter bus, oya make we dey go now, we no fit go because, one student don dey craze. see me see blessing, person dey craze, no be to tie am down, the medical professionals no use dem sense, na so we come get to lock our sef inside because  d boy wen dey craze dey run dey come inside d bus. We dey inside for 2 hours before him mama and papa come. And we come fit come outside. I don already dey shat; Holy Ghost takes control for my mind, because Na another story, we for dey talk. TO GOD BE DA GLORY WATCHES AT FOR PART 3
BTW: Time don deys go, so I get to go. Wen I post again I go talk how HOD take talk true, and the person wen remind me say, I never blog dey ask me the name of my blog; imagine mschewwwwwwww .So therefore no special shat at. And I dey go back house, so no more constant internet. My Clazzyness get price, so e get were, e dey stop. Plus my blog as been viewed 74 time maybe by me half of the time PRAIZEEEEEEEEE DA lORRRRD. Hallelujah……..

PART 1


As, I wan use talk am now…….but if u ask me, Na who I go ask. Plenty plenty tins don happen dis pass week.  I dey studio now, and I dey do research download and usual, I never baff and I dey smell near one fine girl. Any way back do the issue at hand, for this post na my week in review I go do, and no be small Nigerian film, I act, with me of course as d star of d film. And I typical Naija fashion, one part is just not enough
SATURDAY: I dey for school, and people dey go house as school don vacate (department say make we stay behind), I wan vex die, no be say I won go house, as my house rent go soon expire, I go explain for another post. I dey vex sha, and on top dis yeye good school, come tell us say make we pack commot for d hall, wen we dey go another hall. Na so we begin dey carry load, dey go another hall, and my load plenty well well, I be like woman wen marry rich man, and I dey pack my load dey go him house. As I reach dey front of the other hall I come dey follow dey play, person com crack foolish joke, na so I come purse the person, d next thing wen I know na ground I dey. I fall go front but wen I land, Na Sidon I dey Sidon, my bodi don scatter and my clazzy sweater from London, come tear( so next semester, when you see me with sleeveless sweaters, no ask me question, as it is the new trend for men) I injure for all my bodi. People come dey laugh me, me sef, I no know wetin to do, so I come dey laugh too… …..
BTW: the post too long, so watch at for part 2…… make d one person wen dey read d blog, no come say I dey boring, so I go break am down. See as my friend wan happi die because of skype.Na wa oh, on top Skype, all clazzyness is lost. Money good oh, see as she dey use pro book and e fast, no be like us wen we dey use TV, dey deceive our self myself say we get lappi, jealousy and, once again my own is on day way Ahmennnnnnnnnnn

Friday, 3 February 2012

POWER


Power dey sweet well well, I no won blog about this b4, but I just have to. I just dey my own jeje dey write exam, wen I no no who lecturer be(one of does courses, wen no fit put water for my cup, not to talk of butter for my bread) I dey jeje, dey write wetin me, I no no, dey do my guess work jete by jete and dey use my, glasses dey spy, nai one of the NFA invigilator, come dey miss yarn say, me I no dey sure of myself, say me I dey spy d girl work, of course I denied it cause, at that time I was not spying  her work, the man come seize my paper, he come one disgrace me for general pubic dey push me. I no even mind am self, I carry myself commot for d exam hall, as I dey go I come tell am say make him no forget to submit my paper, him give me the paper, make I go submit. As we dey go, na so e take dey pinch me, dey push me , dey tell me say, my mouth go put me for whahala and I go, go back my papa house go start life again. See me; see blessing oh, all this drama on top course wen Na ZERO unit. I no blame am, Na him go, go start life again from him village. Before una use stone take stone me, I know say I dey wrong but, on top zero unit course, dey guy go too far, wetin make e go dey pinch me for back, I resemble him pikin mschewwwwwwww
BTW: my department say, make we stay school for one more week, whether Na dem go feed me, I no know. And they girl wen, dey studio with me dey sing like man, all dis…… make I close mouth, before I miss jarn. Before I forget, I want to give a, shat at to miss pierce, for being d first, follower of dis blog, and if you read or I force u read my blog, biko comment, so I no go dey feel funky, wen e be say na people for china, mistake come across the blog.
I don talk am now……..