Power dey sweet well well, I no won blog about this b4, but I just have to. I just dey my own jeje dey write exam, wen I no no who lecturer be(one of does courses, wen no fit put water for my cup, not to talk of butter for my bread) I dey jeje, dey write wetin me, I no no, dey do my guess work jete by jete and dey use my, glasses dey spy, nai one of the NFA invigilator, come dey miss yarn say, me I no dey sure of myself, say me I dey spy d girl work, of course I denied it cause, at that time I was not spying her work, the man come seize my paper, he come one disgrace me for general pubic dey push me. I no even mind am self, I carry myself commot for d exam hall, as I dey go I come tell am say make him no forget to submit my paper, him give me the paper, make I go submit. As we dey go, na so e take dey pinch me, dey push me , dey tell me say, my mouth go put me for whahala and I go, go back my papa house go start life again. See me; see blessing oh, all this drama on top course wen Na ZERO unit. I no blame am, Na him go, go start life again from him village. Before una use stone take stone me, I know say I dey wrong but, on top zero unit course, dey guy go too far, wetin make e go dey pinch me for back, I resemble him pikin mschewwwwwwww
BTW: my department say, make we stay school for one more week, whether Na dem go feed me, I no know. And they girl wen, dey studio with me dey sing like man, all dis…… make I close mouth, before I miss jarn. Before I forget, I want to give a, shat at to miss pierce, for being d first, follower of dis blog, and if you read or I force u read my blog, biko comment, so I no go dey feel funky, wen e be say na people for china, mistake come across the blog.
I don talk am now……..
No comments:
Post a Comment