I don come back, and Na still Saturday (pls check at, d earlier post). As climb up, I come look my bodi, as I injure, all my skin don scatter finish and toning Bleaching don dey I vain. the situation big pass me so, I decide say, I go, go hospital with my friend, as we reach hospital dem treat me finish, we come say make we go outside school go buy food, as we dey trek come back we come see the hospital bus, dey park inside d hospital. Na me I come remember say, I clazzy, so I no fit dey trek. As we reach, we come enter bus, oya make we dey go now, we no fit go because, one student don dey craze. see me see blessing, person dey craze, no be to tie am down, the medical professionals no use dem sense, na so we come get to lock our sef inside because d boy wen dey craze dey run dey come inside d bus. We dey inside for 2 hours before him mama and papa come. And we come fit come outside. I don already dey shat; Holy Ghost takes control for my mind, because Na another story, we for dey talk. TO GOD BE DA GLORY WATCHES AT FOR PART 3
BTW: Time don deys go, so I get to go. Wen I post again I go talk how HOD take talk true, and the person wen remind me say, I never blog dey ask me the name of my blog; imagine mschewwwwwwww .So therefore no special shat at. And I dey go back house, so no more constant internet. My Clazzyness get price, so e get were, e dey stop. Plus my blog as been viewed 74 time maybe by me half of the time PRAIZEEEEEEEEE DA lORRRRD. Hallelujah……..
No comments:
Post a Comment