Take am say this story, e fit be lie and e fit be true, so Na your choice to place am for either fiction or nonfiction, but the level of classlessness’ wen people go stoop to dey baffle me sometimes. Say man wen don marry with children go dey follow another married man wen get pikin on top bike around town, dey check wether him dey cheat on am, na beyond foolishness. No be cheat una two dey cheat and as you don marry you no go commot for ashawo work. All I have to say is, big SHAME on you, as you old reach. I suppose get your details, send am to Linda ikeji, as e be say Na Nigerian film you won dey act up and down and you won be star. Shame no even catch you small. If person say Holy Ghost, don catch am because say your soup no sweet, you no go go house go cry for your wife breast. Can only imagine what the poor woman is going through, for her mind she don marry, not knowing say, Na honorary lesbian she be. Girls, make una open una eyes before una marry, marriage no be for everyone and no be by force. Say you be 35 and nobody dey show face, no mean say na the first person wen propose nai you go gree for. The symptoms are always there, for you to see all the things you don’t need in your life .abeg no settle for less (note to me too) you too valuable for anybody to treat you like rubbish. Anyways, as for dat yeye husband….one day bush meat go catch the hunter
BTW: To say, boredom get address Na my papa house e go be. I don dey dis house for 1 week and e be like say na Rapuzel or Cinderella I be, wen dem trap for inside castle. Na so so think I dey think, and for the past one week light never dey and On Sunday all the guys for house no go church, When my mama come back na so holy ghost fire full everywhere .so next Sunday, na under da canopy da lord I go dey. And note to the person wen promise me pass to d big event wen dey come up for Eko, if I no go, please defer your academic sessions for the next 3 years.
No comments:
Post a Comment