If you lose control, then you lose everything. na so I take tink am. I too dey fear, I dey fear wetin never happen. And so wetin, if the tin wen I dey fear happen, so far say no be death, hope still dey. Say the person wen u love, no want to love you again….. no problem.E mean say, betta loving is ahead. Abegg if anytin won happen make e happen . Na only my actions and beliefs I fit control. So I go face my fears, make you sef do d same
BTW: I dey studio since morning and na so I waste my time today,dey download won series wen I tink sey, go give me betta tips *wink*, only for me to find out say, na yeye series, wen the woman, they talk say she no fit do d tin again, because of reasons best known to her, some oyinbo sef.. na wa, if you try dat for some places den… OYO is your case and today I baff before I come, so I no smell….. PRAIZEEEEEEEEEE da LOR , HALELUJA
No comments:
Post a Comment