As I sidon for here.. I neva baff since morni and my ampit dey smell, even me sef wen get di bodi dey die for the odor , na wha oh… na wish day I go commot for dis my PIG-GI-RI-GI life… God dey sha.
I Don dey draw *architech in da makin, u wan tryy God*wan betta (God no go make am yeye paper) for here since morni (na who I dey lie give) na ink and download I dey download since morning, the pple wen I meet for here sinse 8 oclock don baff, brush, chopp, commot, some do even love dem seff and dem don come bck, dem still meet me for here.. I dey beg mysef make I change commot for dis kain life. Na so so plan we *cough* me I dey plan, no ashon, well na small small sha.
BTW na pidgin go dey take write dis blog and all wetin I dey write na red e dey com out as. I need to created pidgin dishionary to avoid error
And all dis 100level shidren just dey love dem sef for here.. una never start (jelousy) lol my own is on da way HAYMENNNNN
No comments:
Post a Comment